Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: How ona dey take survive for this our country (Nigeria ).
by
Pokapoka124
on 14/01/2024, 22:40:27 UTC
Things don too dare for Nigeria now. For my area, rent don increase by 50% this year. Some landlords just use brain give their tenants quit notice for November last year say them won use their house do something. All those one na format, them won increase rent and them know say the old tenants nor go like pay. My guy, everything just dey high, even pos charges don increase. Who nor get business wey dey fetch money go really hear am this year.