Good morning and happy New year my people...We are still in the spirit of new year though hustle don start ✌️✌️
The matter wey I bring come goes like this...I dey see...dey hear how people dey take their own lives after the much hustle just because their hustle never pay.. but una go agree with me say life na precious thing... cause na who dey alive go fit eat the fruit of his/her labour (investment)
Most of us go don see the post about that lady for Lagos wey dey work for bank wey take her own life .. according to her say economy don too bad ...she no see any bright future but people in this same economy dey build houses.. buying cars... businesses are doing well.So even as the year don begin and as we Don start our investment make we no still rush to get profit now now so that we no go use pressure go kpai ourselves...life sweet🙌🙌 and na only one dey,,,make we think am
Omo, if hustle never pay no be wetin go make person take his/her life or dey depressed but to continue dey double Ur hustle and pray to God. Life too precious for any one to take his/her life despite de circumstances may be de country hardship dey but people still dey survive and ee get people wey Ur condition better pass and dem never think am to kill dere sef so that alone supposed to be inspiration . She wey dey work for bank and earn salary every month e get thousands of people way dey find her kind of work to dey survive and dem go dey happy.
De country cost living dey high, hardship dey and no job. Make everyone jus try dey manage dere sef small small with de little U dey get, one day ee go better because most people wey get money all of dem too pass through and dem no take dere life but today now dem dey happy.