Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Be careful when doing transaction
by
Hatchy
on 16/01/2024, 06:04:52 UTC
My fellow naija board greet you all!
Please always be careful and always do any transaction with cautious, crypto might disciving you that the amount you loss might be small in your eyes but ones you turn it to our Nigeria currency Omo you go know say nor be small money you loss so ma people make we try our best to keep our asset safe.

Well my brother, this na one major mistake, wey many of people Dem for crypto world Dey make somany times. This cryptocurrency of a thing, Dem no dey rush dey transact am. Once you make mistake, your money don go. As @ DaNNy001 Tay talk am, you no supposed dey write wallet address for any reason. That na why every wallet design the copy and paste button. This one go help you reduce the risk of writing wrong address and loss your money. E no get how you fit take get am back because dis one no be physical something wey up you fit trace the name of the person wey you send am to. So abeg our people, make una try dey careful for this kind matter.

Also, sometimes wey I still wan tell you @ I_Anime be say, this your airdrop group you still need to dey careful as this wan fit still be scam attempt. All these people Dem wey you meet for Internet, Dem no dey see truth for them mouth. Dem fit be hacker and one way or the other, Dem go make up dis lie, so that those greedy people Dem wey dey Dem group go mumu paste Dem wallet address. For something like this, de go lie say Dem receive so so so amount then Dem wan share am for people wey dey active for the group pass. When. You drop your wallet address, you fit Dom expose am to hack. And any more wey dey there fit vanish. Even money wey go come there later go fit still disappear because Dem don hack am. Abeg make we try dey careful for all these airdrop group Dem.