I agree with you, this online platform called affiliate and it online programs, at first the way this people wey dey advertise am go use mouth talk am like say this stuff na to just sign up for the program and e go dey that easy to generate your own funds. Myself, I buy one wey Dem dey call digistem, with the way the person way refer me to the platform take talk am, I come dey assume say this one go be another sure side hustle oh, I say make I register for this platform. I stay for that platform dey follow all their instructions and tutorial videos and also dey implement wetin I don grab. Omo I no go lie for you, e nor dey easy as this people dey talk am, their own na to convince you make you pay for the course, because na there their own percentage dey come from. I will say nothing good comes easy Sha, but the site na legit one