Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: A Skill or a degree
by
Hatchy
on 17/01/2024, 14:52:32 UTC
~

Well, for this one I no go agree with you. That wan be becos both skills and degree dey very important for the country wey we dey so. As Dem dey talk am for we country, person supposed get pass two source of income wey e fit dey survive put for this hard economy. Normally, the rate of unemployment for we country dey very high as work no dey, government no dey provide job for the youths. Person go suffer go school for how many years come out as a graduate with certificate wey no get use. The thing dey pain so many of our brothers and sisters well well for body.

For job market today, employers dey find people Dem wey get experience for many aspects. If as a graduate, you no get skills wey dey based on watin you study for school, e fit hard you as these employers Dem dey always find experienced people. This na why e dey advicible for parents to carry Dem children go learn work at a very young at, as this wan go later come in handy for future.

Without skills, you fit no get work. without degree, you fit get work but you no go fit grow go higher ranks. Both skills and degree dey work together as one. And for person wey wan reach correct position for work, e supposed get both.