From my own side I go talk say the two of them na actually prediction because even after you dn run analyses you no really dey sure of anything. I dn ask people wey dey into forex but some dey claim say e dey different. If you get idea about the two i go like know if anything really dey different for the two of them
The two of dem dey different but first make I clarify you on the words wey you use. Forex is too big to dey compare am with bet9ja, bet9ja na just a company in sport betting no be say na gambling in general while Forex na the trading of all fiats currency so wetin you fit use compare bet9ja na just NGN/USD trading pairs but we understand you because na we we dey here. Rename your thread, Sport betting Vs Forex. This type of topic sha we dun discuss am well for this board but I go throw in small thoughts of mine. The two of them dey similar in some ways as they have to do with making prediction but them no be the same as them get their difference.
Some of the things wey make dem dey different include;
- Sport betting is just a prediction of which team will win a match among the two teams playing while Forex trading is the prediction of how the market is going to move so Forex dey more serious than sport betting.
- Sport betting isn't a skill but Forex trading is a skill that can be learnt because trading is teachable and can be reciprocated while betting isn't.
- Sport betting depends more on luck but Forex trading depends on your level of understanding of the market. If you no sabi trade you no sabi but you fit use your luck pick team wey go win and you win.
Big difference dey between sport betting (as na wetin be9ja be) and Forex trading so make you no dey follow people mouth wey dem no know wetin dem dey talk. Sport betting no be serious career path to follow but Forex trading na very big career path wey go fit make you bastard money wey sport betting no go fit give you. Once you know Forex you dun know am and na steady cashout go dey come your side but sport betting just belike wetin you go dey do for entertainment and you no supposed take am serious.