Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party, pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people. Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street, you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
Nah so oo imagine person wey get iPhone 15 dey try oppress landlord

this country get as e be oo, like this all this fake life things nah poor people day do am, because person wey get money no go ever show him money to any one but no try poor man oo. Although many men dey enter this fake lifestyle just to impress the ladies as them too nah money dey their head. Some girl wey dey do fake life are just doing it to prove expensive lady in order to get rich guy wey go fit spend real money for her.
Imagine a girl borrows an iPhone 12 just to go party and do fake life oo. luckily enough in the process of the fake life acting phone fall screen break she begin dey cry and sweat, say she borrowed the phone from some thug guys wey dey her area just for the party and now phone don break she know know how to explain give the thugs wey get the phone. Abeg this one no be wahala she go buy by her self because she no go gain anything but only enter new problems again, wey solutions for those problems self go hard wella.