From my own side I go talk say the two of them na actually prediction because even after you dn run analyses you no really dey sure of anything. I dn ask people wey dey into forex but some dey claim say e dey different. If you get idea about the two i go like know if anything really dey different for the two of them
The two no be the same time at all just that both of them get something in common which is the aspect of risk and predictions but for forex your predictions no dey like bet Naija wey na forecast you dey do , you gats do analysis based on one or two things wey you know and this things na things wey you go learn first, na why we dey get forex academy but you no go fit see bet9ja academy because forex na skill wey you gats learn make you use am do your work but e no be like dat for bet9ja , dem no dey learn or use bet9ja do work, people dey invest for forex wen dem see people wey Sabi do forex well but nobody dey try am say make dem invest for bet9ja because dat wan na 50/50 but forex if you Sabi am well you fit tell how much you go fit make for one month or even within weeks, plans dey gats dey wey you go follow.
The two of them no be d same tin but dem share some kain similarities but e still no make dem d same, professionalism dey forex but e no dey bet because bet sef no b to make money dem do am for na for jus fun wey fit pay u but forex na work wey gats pay u.