Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The fall of shitcoin/altcoin, the rise of bitcoin
by
Makus
on 26/01/2024, 09:31:16 UTC
Just as the name implies "shitcoins" they have no volatility at all as all we experience from this shitcoins is just pump and dump as the people that introduces this shitcoins knows perfectly well that those coins can survive the crypto market where there are more volatile cryptos like Bitcoins that has higher volatility and everyone's interest is mostly on Bitcoin so definitely, as Bitcoin surfaces all other coins tends to fall and vanish in other to make way for Bitcoin to still maintain it's high profile among other cryptocurrencies.

What increases Bitcoin adoption the most is it's sustainability because Bitcoin over the years, has stood out among other cryptos thereby making it future to be guaranteed on like some shitcoins that rises as a result of hype and later on perishes and any investor holding such a coin will definitely run into losses.

Guy e be like say you dey mistake the definition of Bitcoin and shitcoin, before I clear you for that part, I go like make you know wattin shitcoin be. Shitcoin na coin wey be say dem create for the market wey come get small value come go back down, or coin wey since them create am e go gree get value at all, or you fit call all those scam project shitcoins. Many of those meme coins wey go pump until Dem go come start to dey dump until Dem mo get value again, we dey call those type shitcoins. And besides most of those shitcoins Dem volatile pass Bitcoin by far, in fact Bitcoin no even volatile reach some altcoins for the crypto network. If you observe closely when the market dey experience some pump, you go see say while Bitcoin dey like 6%increase some coins dey count 23% and when the market dey dump na so them dey use that same energy wey Dem use take pump take dump.  And coin like that nor dey too last for market before you go know them don turn shitcoin.

More years to come, altcoins no go fit take the place of Bitcoin for the crypto network. Some of them sef go fall after the halving event as the dump in price go take place after the halving some of those coin no go fit again their sef and na so them go just die like that, beside Bitcoin na long term while some of those coins na just for short period , maybe for just 1 month or 3 before them lost for the market. So una wey dey buy altcoin make una dey careful not to go buy shitcoin wey don already dey go down thinking say e go rise up one day.