Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Quick money wahala
by
Gormicsta
on 30/01/2024, 22:21:15 UTC
Every body wan make quick quick Cash .Gone are the days when youths work hard to earn a living,them no send how the money take come..nai make now scammers full everywhere...nobody is safe . Government too is to be blamed Sha cuz if you go all these government offices no workers yet they won't  employ fresh graduates .Na only God go help us

Before before, our fathers believe in the system and e been dey actually dey work for them, the system that time na, make sure say you go school, get good grades, and graduate with those good grades and then you go land yourself better job, and honestly that time, e been dey actually dey work for them, but now, the system don turn another thing, now we get so many unemployed graduates. Person go go school finish, spend 4 to 6 years for acada, come out with your second class or even first class and then you dey waka from one place to another dey fyn job wey no even dey forth coming, na why I no really blame anybody wey no believe say na school be the way again because the system don fail us.

No be say we government no really dey see wetin dey happen, but them choose to turn blind eyes to our lamentations and complains, so people no go wait for them again, person wey him house dey on fire no fit dey inside the house dey sleep.