Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Wetin e mean and how u dey use this slogan
by
Tuclikk
on 30/01/2024, 23:46:44 UTC
This one na popular slogan wey dey ginger everybody now. How this slogan take dey affect you and how u dey use am for this crypto space
Yeah me self been dea here this slogan time time, but i ask wan of my guy say howfa this wetin e mean, he said that the way things hard now, you no fit give out and live your self with hungry, e no clear at all, the full meaning be say (everyman for himself).


Apart from centralized exchange, no gree for any p2p transaction wey b say na true social media
Na why naija people carry this slogan for head like mad if you wise toh and if you know wise, you dea on your own. anybody wey go bill you through social media app omo me self go talk am no gree for anybody oo, because scammers don full every where now, as this life dey now omoo EFCC sef dey complain too much on this internet fraudsters, this scammers of a thing, their work don even turn to handwork wey you gaz serve your boss before him teach you work.
My brother's and sisters na true oo this year 2024 "No Gree For Anybody".