As we enter the year 2024 , young Nigerians don talk say, no gree for anybody. This one na popular slogan wey dey ginger everybody now. How this slogan take dey affect you and how u dey use am for this crypto space
For me , I go say, no gree for any airdrop wey dey request for money (any crypto as payment) or private keys /memomnics to your wallet. Na scammers dey play with you so. Apart from centralized exchange, no gree for any p2p transaction wey b say na true social media
Bro your basically speaking your own and that dlogan no come out for crypto users or only online people. The main way we suppose to dey use that slogan na in terms of hustling and self development, no gree for anybody this year na say, make you no dey their dey sleep make your neighbour carry your blessing, the thign fit also ckme in for smartness to, which is the one you explained for us, say make we no dey dull dem come scam us, so no gree for anybody u fit still carry am enter church sef, say make u no dey dull, another man blessings pass you. And me as crypto user to add to the one you talk, I go say make we no gree make anything stop us from accumulating bitcoin, make we no gree for any excuse this year, make we go get income raise or anything wey dey necessary to enable us achieve more bitcoin for our wallet. No gree for anybody to me na no excuses!