Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Make una dey careful with online dating apps
by
Blink star
on 01/02/2024, 10:54:28 UTC
This thing way you talk na true talk but according to Igbo people them say the better advice na the one you give yourself because if them tell ear him no hear if them cut the head ear go follow am go grave

This thing make me remember one of my guy Emma this guy anytime way money enter him hand na so him go worry me make we go ashawo quarter and me i be that kind guy way be say if i try to advise you and you dey try to tell me say you sabi pass i go tell you no vex i go come dey pet you to even help you chop the money because i know waiting go happen for front, so this guy before na him be number one guy way be like say him get money pass for our street now because of the way him take chop the money, the money done finish him eyes done open him done go village dey go stay with him mother sometimes if him call for phone dey ask me for money I go dey pity am and i no fit tell am no because na my guy