Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Topic OP
No need to change job due to low salary, just add another source.
by
Barikui1
on 03/02/2024, 15:52:51 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
My country people good evening inside this evening, today e get one issue wey I just dy reason with one of my guy, so I just say make I share this idea, if e go make sense to some people or not.

The issue na concerning one of my guy wey dy tell me say him dy find another work because the one him dy do, the money too small , say e no dy reach him and his family again, so I ask am how much dem dy pay am? Him say na 90k, i just weak as him tell me the amount, I tell am say, bro ur salary dy fair enough to dy complain like this na, just look for another thing to use double ur hustle, no need to dy look for big job wey no dy come, I even suggest Bitcoin and other business wey him fit add up with this his regular monthly salary.

So why I dy talk all this tins, na to let those people that need to hear this, that most times, no be our job dy cos our financial difficulty, na  due to poor salary and inflation, na just lack of different sources of income dy cos am, see make I tell you, if you get like three different hustle wey dy pay you the least, weekly or monthly bro you go do well more than you go even expect, just reason wetin I just talk now.