Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Hitting the Street is Inevitable
by
Hatchy
on 04/02/2024, 02:45:40 UTC
~snip

Well brotherly, we done complain tire for this country but nobody dey listen. Even though say we continue na our own be that. Na e make me no dey stress my self again but live life the way I see am. Price of things dey fly like say tomorrow no dey. Hungry full every where. Person self wey dey earn dollar still broke like. The country no dey sweet anybody at all.
E no get riot wey we go do to fit help at all bross. These politicians Dem wicked just like watin happen for end SARS matter, Dem open fire for peacefull riot. Abeg make we dey hide if all those kind things dey o.
Just yesterday I dey watch one video for my watsup, as I watch am, I felt ashamed of being a Nigerian. Can you imagine an international airport nepa Dey take like. For hours I see for the video say oyibo men Dem on torch light to take see for inside airport like why Nigeria?
First thing, for place like that, Dem no eve supposed dey use light but government supposed mount solar for that area so as to provide 24/7 light give Dem. Why Dem go dey use nepa light for that kind place. I watch that video I wan cry for this country. E no get watin we for do but t survive an work harder bross.