So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
I go just go straight to the point answer you wetin I feel say be the major reasons why some people dey easily lose interest or get tired of the forum especially the newbies.
1) Wrong Orientation: First of all we understand say some people dey bring other people come here but Dem no dey open up tell them as the place be and how things take dey happen for here so when dem talk to them up up when Dem come enter as soon as wetin dem expect to see no be wetin Dem see Dem go just tire for everything.
2) Lack of adequate study time: some people wey enter forum no dey take time well to study this place before Dem begin posting, most people wey stand well here today go confirm say Dem been first learn from others wey dey here before Dem before dem start to dey hustle but lately new comes wam just dey do tins on dia own forgetting say e no easy like that. I foe like continue but for the sake of time and other things make I stop here make others also put mouth 👄.