Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 3 from 1 user
Re: Why some newbies dey quick lose interest for the forum??
by
Cityhunter34
on 05/02/2024, 13:57:46 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (3)
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
Well done op, the thing wey I wan talk be say make we no forget say newbies dey like apprentice and imagine after putting so much work creating something to impress your boss/teacher em come tell you say wetin you do no dey worthy, this one na complete emotional damage, no be everybody fit take criticism as human go always be human. I don Waka for this forum and I dey see plenty criticism for person (newbie) post and my take be say this place no be for the weak at heart.

Two things wey I know say dey make newbies run from this forum na impatient and the criticism wey dey come from high ranked members. It will be very hard for any newbie to survive if they don't have patience and can't take criticism.

 My advice to other newbies be say make una develop toff skin if you wan survive, criticism no go kill you, e go only make you better if you use am well, if person criticism your post e no mean say the person no like you em want make you learn from your mistake and take correction. Me self don collect my own share of criticism and e really enter me but as I don go through wetin cause the criticism I go make sure say I correct myself next time.