The first step starts with us as Nigerians.to do the right things!!
Human being by nature no dey do the right thing or a greater population of human being no dey do the right thing. No be today e start even from bible, there is disobedience that happened at different times.
Wetin dey different with other jurisdictions wey things dey work and Nigeria na law wey dem dey obey and keep to the punishment both for big and small if no be so, na as Nigeria dey lawless na so those countries too for be. If you also check their history when dem never grow to modern countries, na so dem too dey lawless until dem improve and to improve na for leaders hand e dey because dem must agree to dey obey the law.
For naija, no be the masses hand e dey to make the country better but na those wey dey elected to uphold the law. If dem dey flagrantly abuse the law, na how the masses go do the right thing when dem know say the law just dey like toothless dog.