My country pipo e go really make sense if you wey they seek for admission into the university learn at least skill wey fit fetch you income the reason why some of us find am hard in school na because we no learn handwork (skill) so the thing come become very difficult to even concentrate properly some days wey nothing day no food no money to go class go worry you and all this things really dey discourage somebody well well, those wey learn handwork before gaining admission into the university no really face much difficulty because them get service to render in exchange for cash
Op wetin u talk no be lie.E good make student wey dey aspire to enter university learn one skill wey ehn fit use am hold e side for school.My neighbor dey gist me oneday say the skill wey she learn before she gain admission to the university really help her for school,she tell me say with the little money wey she dey make from the skill wey she acquire she dey use am buy textbooks,food etc.Omo as she gist me I say I go find one skill learn so that I fit dey use that one hold my side.
aside ur schooling e dey very important to learn handwork before u enter school because that time your brain still dey young and not much responsibility to think of unlike when you finish school to come learn some settings kind of handwork that time go dey very very hard because you done dey think about your responsibility at hand and that time u fit no get chance unlike now wey you still dey mama and papa house this na my own experience and my regret.
Currently now dis generation e no too dey late oh, because student dey gain admission to the university at a very early age, for example make I just say 17 years old child gain admission to the university to study 5 years course,and at the age of 22 that child go don round off,so e no dey too late for 22 years old person to learn skill.