Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: How dollar rise take affect the prices of things?
by
Gozie51
on 09/02/2024, 22:07:37 UTC

I wan really ask how dollar wey oyibo Dy use Dy take Dy affect the prices of goods and services for our country because if to say na only goods wey dem import I for say na the exchange rate when making payment but how e take affect things wey we they source raw materials locally come produce here like garri, rice, indomie, cloths, and other things


As Nigeria dey so now, na two things dey make price high and them be fuel price and dollar to Naira exchange rate. Okay for the fuel price now, when transportation put money because of say transporters buy fuel high so market people too go add money for wetin them too dey sell because them need to cut cost too, nobody want gree for anybody.

For dollar own nko, we sabi say naija no dey produce something and so most of the things wey we dey use na by import and you have to buy dollar to do that so it gives dollar more value than Naira plus the politicians wey dey store dollar for their houses. Some politicians and governors no dey use naira but dollars and that further weakens the Naira. Some countries wey dey serious dey use their currency for anything dem want do.