The time is now to start thinking about the future and stop living extravagant lifestyles trying to impress people who wouldn't even know how you are doing when you peradventurely fall.
As you no plan, you dun automatically plan to fail. If you no make good use of your youthful days, when you dun old you go still dey suffer dey work from hand to mount. All this old men wey dey work as security men today fit be ballers in their youthful days and dem forget to invest so make we try not to belike them by doing what is needed to be done to have a fruitful future.
As you dey get money and all you dey think about na how to impress people wey be say dem no even fit get wetin you get na when you no get that money again, na dat time you go know wetin you dun do with your life. Planning your life by investing into assets is necessary, na assets wey you buy today wey go rescue you tomorrow when everywhere dun dry. This money no dey dey foolish man hand forever as you go disrespect am by wasting am for liability them na so the money go dey move away from you.
No live extravagant lifestyle when you no get assets wey go fit take care of those bills without having to use money that are meant to be seeds. No go dey flex money wey you suppose to dey invest. Just arrange yourself well and live in a comfortable way then invest the rest into assets wey go dey multiply your money and not only storing it.