My country people, I greet Una o. Abeg I go school graduate o but e get one thing wey I Neva really understand and I believe say the forum na the best place to ask the question. I wan really ask how dollar wey oyibo Dy use Dy take Dy affect the prices of goods and services for our country because if to say na only goods wey dem import I for say na the exchange rate when making payment but how e take affect things wey we they source raw materials locally come produce here like garri, rice, indomie, cloths, and other things
This thing Dy really make me struggle and look for means to earn in dollar.
Abeg I Dy wait for replies if possible use graphics, practicals, example and illustration anyhow wey I fit use understand am.
Na very thoughtful question you ask. I hope you still dey follow this thread make I for lend my voice for the contribution. I no be really economics student but I know small how things work. Make I highlight things out;
- Majorly electronics are impacted directly by dollar because na direct dollar to naira trade
- Another thing wey dey high goods na clearance for airport
- Major thing wey dey high domestic goods no be dollar but cost of transportation which wetin cause am na high price of fuel
- Upon all these, global inflation still dey
- Again, the effect of recession wey Nigeria enter years ago never commot
We no dey expect better unless go save us.