My country people, I greet Una o. Abeg I go school graduate o but e get one thing wey I Neva really understand and I believe say the forum na the best place to ask the question. I wan really ask how dollar wey oyibo Dy use Dy take Dy affect the prices of goods and services for our country because if to say na only goods wey dem import I for say na the exchange rate when making payment but how e take affect things wey we they source raw materials locally come produce here like garri, rice, indomie, cloths, and other things
This thing Dy really make me struggle and look for means to earn in dollar.
Abeg I Dy wait for replies if possible use graphics, practicals, example and illustration anyhow wey I fit use understand am.
I understand say maybe you think say na only to dey import goods dey make naira fall and dollar com dey go up but then you need to understand say apart from those final consumables wey we dey import we dey also import raw materials wey we dey use to facilitate local production especially in the transportation system and dat na why e dey always affect even w b say na our locally produced products dem, because when dem produces dis tinz dem, na transport dem dey use move am from one place to another but then we now no dey refine or produce our petroleum products so when dem import am at high price e dem make the transporters increase the price of d fare too.
Another tin b say when things hard like did local producers dey carry price up so dat dem sef fit survive de economy and still dey in business because we no dey get everything locally, even for local production we dey need some foreign materials to help facilitate all these things.