Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Importance of learning a skill before gaining admission into the universIty
by
Kliss
on 13/02/2024, 14:52:40 UTC
My country pipo e go really make sense if you wey they seek for admission into the university learn at least skill wey fit fetch you income the reason why some of us find am hard in school na because we no learn handwork (skill) so the thing come become very difficult to even concentrate properly some days wey nothing day no food no money to go class go worry you and all this things really dey discourage somebody well well, those wey learn handwork before gaining admission into the university no really face much difficulty because them get service to render in exchange for cash aside ur schooling e dey very important to learn handwork before u enter school because that time your brain still dey young and not much responsibility to think of unlike when you finish school to come learn some settings kind of handwork that time go dey very very hard because you done dey think about your responsibility at hand and that time u fit no get chance unlike now wey you still dey mama and papa house this na my own experience and my regret.



Na true talk learning handwork before U go into higher institution go help, especially when U know Ur background. Ur hand work go make u dey different for school U no go lack money, because U go dey work wen u get chance so dat money go dey Ur hand to assist Ur self. I don see friends wey get handwork before  University and ee give dem advantage for school during dere weekends or if dem get chance dem go go hustle with dere handwork get money, but de thing dere be say na to make sure make ee no affect ur studies. This matter dey important well well especially for young ones wey never go higher institution and now wey dem get fewer responsibilities ee go make sense now to learn handwork(skill) so dat wen U enter school U go dey benefit from am ee go make Ur higher institution experience easier and wen U graduate sef u go still dey use am package Ur self.