My people I dey greet una, abeg make una no vex for this my post. Na something wey just happen to me today I come say make I carry come here as e fit help other newbies like me. If post like this don already exists abeg make una let me know so I can delete this one. My fellow newbies abeg before we send our crypto to any exchange, make we do well to check the minimum deposit well before sending it to avoid asset loss.
Na better talk you carry come ooo, my friend don complain about similar thing before, him send money go one exchange like that wey I no really know the name, the mistake wey him make say him no check the minimum withdraw for the exchange, since him don dey use the exchange before and him never get any deposit problem, but as him send dis particular money, the money hang ooo, e no enter him wallet, as him go dey do more research, na him the guy see say the money wey him send no reach minimum deposit, na so the money no go enter, and Wetin funny me pass be say, the guy no get any money for hand, and him really need the money.
Dis minimum deposit for exchange na Wetin some people no dey carry serious, because even me I no dey check am before, but since my friend tell me about this, I dey always check minimum deposit, minimum withdrawal, the minimum amount wey I fit trade for the exchange before I go start to dey use the exchange, before na when person no get money, and you wan commot small money for emergency sake, na when things like this dey always happen.