Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: How dollar rise take affect the prices of things?
by
uchegod-21
on 14/02/2024, 23:00:26 UTC
Na the effect of your country being a consuming country and not a producing country, wetin we sabi for this country na to just dey consume and we dey import 90% of things wey we dey use for this country and when we dey do international deals na dollars we dey use so anytime wey we dey import and is being affected by the price of the dollars.
No country dey make better progress if the only thing dey depend on na import and consume. This thing don worry Nigeria wella and including other African countries. This na thorns for the flesh of African countries.

Lastly, out of greediness some market women and men go always take advantage of the increase of dollars to increase their own prices even as na old stock while some need increase even though na old stock because dem need make profits to use buy the new stocks when them go go market go buy new market.
This one na the real Koko boss man. We Nigerians sabi take unnecessary advantage over our fellow Nigerians. As the way things be now, you go notice say 3 grocery stores in your street are just selling different prices. Many of those prices are not market prices but just generated by the sellers in the name of bad economy.