Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 4 from 3 users
Topic OP
Road to Bitcoin bull run
by
Kelward
on 15/02/2024, 18:00:16 UTC
⭐ Merited by Hatchy (2) ,CryptopreneurBrainboss (1) ,Charles-Tim (1)
My naija people I hail una, I hope say di dollar to naira rate wey de make our beloved naira to devalue everyday no too affect una Bitcoin journey to bull run. Anyhow we wey know wetin de for crypto matter suppose try to de do DCA method to de accumulate and hodle Bitcoin, no matter how small, because in approximately one year  time from now, hopefully we go get plenty ROI. Bitcoin halving de happen like leap year, because na once in every four years e de happen, and from research, after e happen na new ATH go follow within the next year.

So dis thread na morale to us say make we no give up for our Bitcoin hodling , based on di economic hardship wey we de face for our country now. Who sow in tears go reap in joy and happiness, e no easy but make we no give up, in di end success is certain. But las las, Bitcoin accumulation to bull season no be do or die affair, if we try  but no get money to de buy Bitcoin, because of di coming bull run, make we no kill ourselves, after dis bull run other bull runs go still come in the future.