My pipo as we all know say the matter concerning nde rate of how Dollar take dey strengthen over de Naira, Na something wey get negative and positive impacts for fellow citizens. Some of us get friends, brother, pipo around us wey dis thing dey affect dem either good or bad. I get friends wey dey earn $200,000 weekly and because Naira dey week de guy dey acquire better properties and other assets and him happy as the Naira dey week because him earnings get big value and I also get friends wey dey complain negatively about de situation.
Na advantage to some persons and some pipo dey benefit as Dollar increase because some pipo wey invest for bitcoin go get higher returns and pipo wey their jobs dey pay in dollars and businesses also wen dem convert am to Naira na better monie and dem dey happy to earn in dollars because de monie big value for Naira and dem dey meet up no matter de hardship and cost of things for de country.
Na disadvantage to other pipo because the prize of imported goods and services go dey on increase and ee go affect businesses and pipo wey dey patronise dese products and plenty things wey we dey use na mainly imports.
With d dollar increase which one U know say dey impactful to u.