Good morning and happy New year my people...We are still in the spirit of new year though hustle don start ✌️✌️
The matter wey I bring come goes like this...I dey see...dey hear how people dey take their own lives after the much hustle just because their hustle never pay.. but una go agree with me say life na precious thing... cause na who dey alive go fit eat the fruit of his/her labour (investment)
Most of us go don see the post about that lady for Lagos wey dey work for bank wey take her own life .. according to her say economy don too bad ...she no see any bright future but people in this same economy dey build houses.. buying cars... businesses are doing well.So even as the year don begin and as we Don start our investment make we no still rush to get profit now now so that we no go use pressure go kpai ourselves...life sweet🙌🙌 and na only one dey,,,make we think am
I pray make we know see any pressure for this life wey go make us to take our life. Imagine people dey kill their selves just because economy dey very hard, this kind of news dey surprised me oo. Shey na only them dey face this hard economy? This hard economy touches everyone of us in this country, if we see say na our own worst pass, many people dey wey dey see shege pass us, Some people no dey ever appreciate God wey create them for once at all!! That lady wey kill herself so, she no even thank God say she dey work for bank, she finished school, she still get a job with her CV, how many graduated students dey this country wey dey waka up and down everyday just to get a job but them no even get one, she get work for bank and kill herself just because of the hard economy.
I believe say our problems no go ever be the same, but if we take our life waiting we go gain? In this life make we know rush, everything is just step by step, we no fit start investment and be thinking, it will soft immediately, we should have patient with time we go get profit, as Op said it, life is really sweet my brothers.