My country people I throwaway salute give all of una for this morning/afternoon/evening depending on when you see this post. This morning I dey listen new for radio I come hear when dem dey do newspaper review, them come read in headline say federal House of representatives don dey make move to discuss say dem wan stop sports betting, them no give full details and reason why this move wan happen because I no know weda diswan follow dey affect our economy wey dey cause hard time. This thing if e happen say dem stop am e go get negative and also positive effects on the street and by extension the whole country population.
So my own na be say how in see this move?? Wetin be the advantage and the disadvantage wey dis move fit get on the society especially the young people them, make we discuss our ideas how una see am.
No matter how them wan do am I no sure say them fit cancel for naija, even if E reach the limit where police dey arrest people about it it will never stop, although I know sporty bet is not something that we go too rely own but street don fall in love with it, yes E get negative impact and positive impact, the negative side be say the thing no dey allow money stay long for the youth hand, many young people in this days, some young guy's don't know anything than to play sporty, and that is really affect the society because many people invest on their people again and he will be spending on sporty.
And as for the government about he ban sporty bet, we just dey see the news and even if it is possible nothing go happen because it will really affect many people, some people dey now wey be say na sporty bet be him work as government no give them jobs, although government get right inform people and do what ever they want but for this one I think government should just no take the matter serious if not shege go dey everywhere.