Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: House of reps moves to stop sports betting in Nigeria (am news)
by
Mr.suevie
on 16/02/2024, 23:37:03 UTC
So my own na be say how in see this move?? Wetin be the advantage and the disadvantage wey dis move fit get on the society especially the young people them, make we discuss our ideas how una see am.

The small knowledge where I get on top this matter, I no think say them fit just remove sport betting for the country but I feel like say them fit try to regulate am to the best of their capacity which cannot stop Nigerians from sport betting. Nigeria no be China abeg, and na only for countries like China such kind of matter fit happen. For other countries, not Nigeria alone, them no fit stop gambling by the government

Make we even reason am say government wan ban people from betting, shey na all the betting sites them fit identify come ban us from logging those sides. As if guys no get VPNs again to tweak their location again and even if them seize the license, boys go look for alternative so nake them just forget about that one use the same energy fight insecurity.
No be small abi dem think say this country na north Korea wey  dem fit restrict people from actually doing anything. Omo me I believe say all this na just cruise wey dem dey catch because it's not easy for dem to  actually stop Nigerians from gambling but regulation it by putting some restrictions won't be a bad idea because this gambling sef don really endanger people life and also at the same time bless people that na why it's gambling so the government should actually focus their energy on something else rather than looking for unimportant things when their is hot problems going on with nation.