My people, I dey greet Una, abeg make no vex like that for this my post I think say e go dey very useful to us if we see people like this on our dm for what app make we no give them change ohhh I use God abey us cause dey just my guy this type of scam.
I am just say make I pass this information mak we use am see front.
Most time we do notice some people who put some office worker's picture and also name themself investor on their profile and say that they are Sports Bet employee, and they just jump into one DM and they tell you if you are aware of No be only sportybet bro. This thing dey common for we country 9ja. We dey receive different text from different people telling us say opportunity dey or whatsoever. And if you no dey careful you go enter problem. Just of recent I don receive message from some random contact say tinubu dey give people #75k say make I call a number to receive my own from Tinubu. Na the message be this below.
ALL PROGRESSIVE CONGRESS (APC)!!! SEND ACCOUNT (FCMB, all sterling bank access bank TO RECEIVE #75,000 FROM BOLA TINUBU EMPOWERMENT CALL 07069559596 TO RECEIVE
So no be only sportybet. Dem dey always carry different formats dey come and if you no dey careful you go enter problem. Sometimes dem go tell you say you don win big money for MTN or any platform wey you no dey participate with any activities self. Dem go text you say make you call them to claim your price so that one na very serious issue, because many people don fall victim and those wey be say them win better something even when people win better thing dem no dey get the courage to go collect am because it is believed that any message them text you for wining na scam. So now to spot the difference between the Wright and the wrong winning don be problem.