Sorry that I did not make it very specific, I been feel say I dun already lay the example of the duration from my own prediction wey I been give wey be from April to June (second quarter)
As e be like this now, my own prediction be say the US dollar to Naira go reach 3000. But then again eh, e nor matter wether na 5k e reach wetin matter be say, our government need to first solve our own internal economic issues first. According to Google, 1 USD to South-Korea Won na like 1,300 but that one nor even concern dey. Dem dey develop dey go. Na the same thing I expect from Naija too. We move from a USD dependent economy.
Las las na bitcoin go still win. Anybody wey fit, make them try dey DCA for BTC o. Na the winning side be that one.