My country people I throwaway salute give all of una for this morning/afternoon/evening depending on when you see this post. This morning I dey listen new for radio I come hear when dem dey do newspaper review, them come read in headline say federal House of representatives don dey make move to discuss say dem wan stop sports betting, them no give full details and reason why this move wan happen because I no know weda diswan follow dey affect our economy wey dey cause hard time. This thing if e happen say dem stop am e go get negative and also positive effects on the street and by extension the whole country population.
So my own na be say how in see this move?? Wetin be the advantage and the disadvantage wey dis move fit get on the society especially the young people them, make we discuss our ideas how una see am.
Na true talk the stoping of betting in Nigeria no really affect the economy but he still good make them stop am because betting dey really affect our youth and most of our teen wey dey play am. And gambling gambling get a lot disadvantage so make dem try stop am because people dey wey don lose their lives because of betting