I will like us to discuss broadly on any of the possible highlights i will be dropping below and give our own opinions on the about the current state of the economy.
1. Will a massive and national protest not emerge soon like that of End SARS, as the people were getting to their elastic limit on economy hardship.
E go long before we go see anything like endsars again for this country, after the outcome of endsars wey people die and nobody dun do anything about am people dun realize say the government no rate us for this country and dem dey allowed to do anything because I no understand how person wey dem say been dey incharge of ordering the shooting later become president of the country. The endsars protect work but people lose their life and their family weren't even compensated so people go look two times before dem join that kind protest again and this na wetin the governments been want so dem fit put fear for our body.
2. There's no plan on increasing the employment rate and minimum wage, what will be the effect of these on the country leaders of tomorrow.
There's no benefits of increasing the minimum wage as no be the solution to the problem be that. If minimum wage gets improved, cost of things go increase too because market merchants and others merchants wey no be government workers go wan benefit from the increase in minimum wage so that one no be solution. Make the government fix the economy of the country first na that one go solve all this problem. Make dem make all the refinery in the country function so we no go dey buy fuel wey dey follow cause all the problems wey we dey face like this.
3. Are we having an incompetent leader or the people around him are the ones causing the uproar for their own benefits, we can remember this, that the truth will always prevail, any illegal achievement will not last for good, because the foundation is evil, is there nothing wrong with the last conducted election.
Suffer say you dey allow people wey dey around you oppress the public and cause an uproar, you're an incompetent leader. A leader supposed make everywhere stew for him people. People vote you there because dem trust say you go change the conditions of the people but you have failed if you no dey deliver and if na country wey dey work, you for suppose set down. Na you suppose dey watch people wey dey around you make dem no spoil wetin you dey build but the government no get anything wey dem dey build but just a confused set of person and na why the economy just dey decline everyday.