Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Government demanding from Binance the lists of its Nigerian users
by
CryptopreneurBrainboss
on 29/02/2024, 23:28:48 UTC
Charles see eh, this matter go long. I tell you. From what I am reading on the internet not from official source though, dem talk say the FG dey accuse Binance based on the following -

If this rumours na true then the Nigeria FG wan just cashout from Binance because say US dun do their own. I been just know say after US successfully make Binance pay fine for the allegations wey dem been give them say other countries go begin dey try their luck and Nigeria no dey carry last so I no suprise to see all this rumours flying around although I go wait first for the FG to come out come talk am demselfs before I go believe wetin you dey talk so. Na the disadvantage of a centralized system be this. Binance need to do anything wey the governments wants or dem go lose the money wey dey Nigeria as alot of crypto traders full their exchange from the country.

They're willing to sacrificed P2P trading volumes than to lose everything, exchanges are only for business so make we no dey think say dem get our best interest. But sha nothing come out for this demand wey FG dey ask about. Wetin dem go use the names do unless dem get their own agenda and get specific people wey dem dey target because I no see any point for this whole discussion.

Tinubu just dey fall my hands self, I thought he was better than all this but I believe say an frustration and cluelessness dey do the man. Him governments never even reach anywhere things dun dey scatter. Make him better bring good policy wey go help the country economy and leave all this ones wey him dey do so as dem be temporary solution and not everlasting stop to the deprecation of the Naira.