Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Cheers to those of us that has no guidance.
by
SmartCharpa
on 07/03/2024, 16:52:13 UTC
Op, e go hard for a person to carry in friend or family brother come to place like this come leave am to survive on it own. Unless you don see yourself as a person way go fits navigate this forum by yourself, and you do not need help from the person way carry you come to this forum or unah two get issues way go make am leave you alone to survives for this forum. something way you go learn from this forum, if e no be person way carry you come to this forum, you no go fit know this thing for the forum. It is good as you they learn by yourself and it will make you to be more motivated to achieve your dreams of coming to this forum.

My brother na true you talk, e no really dey easy say make person survive on his own in this forum. The journey wey dey this forum far, if you no get who go lap you person wey no strong go give up because everything go hard, this forum the beginning hard, sometimes you go even dey imagine say which one you go even deal with shey na your personal issues wey dey worry you abi na the froum wey no dey easy. Many things wey man eyes don see, if person no get who go dey motivate or guide am how this forum take be many people go give up because motivation they really helpful here, e no go make body dey weak. I believe many people wey dey introduced to this forum through someone close to them, they plenty pass people wey just came across this site. Sometimes i go seat down dey appreciate God because e no dey really easy to survive in this froum.