Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Cheers to those of us that has no guidance.
by
Jegileman
on 09/03/2024, 17:40:28 UTC
There are some of us that were introduced into this forum by either a friend, a relative or a family friend and after introducing us to this platform we were left at our own fate without any advice or guidelines on how to navigate through the forum but yet we stood determined to succeed and we starting learning by ourselves, getting helps and information from people in this forum, Google, and YouTube and as time goes on we became accustomed to how almost everything is working now and it looked as if we never had a difficult beginning.

E no really matter the kind method wey you use sabi dis forum as far as say the method work for you and you know wetin you dey do here. Some people come dis forum no be even through person and dem still dey do well dey go. For you wey be say you get person wey introduce you come, at least him go don tell you one or two things about the forum wey go make you dey guided as you just join the forum before you come later dey learn by yourself. Kudos to you as you don come dis far by learning d things wey you sabi for the forum by your own self. Your hardwork, effort and dedication don really pay for you.

Quote
I urge and encourage everyone that feel left alone or abandoned when they were introduced to this platform and I tell you that no knowledge is easier to acquire than the knowledge you sort for yourself rather than relying on others to be your road map. Every little beginning has a greater ending as all you need is to be focused and sort to learn more and say less as those are the channel to arriving your destination.

E good make you get person footsteps wey you go follow, make dem show you d way because of dem no show you the way as e suppose be, e go take you longer time and hard times to fit learn come become perfect by yourself. Whether you learn through person or by yourself, the thing be say make you just achieve wetin your mind dey at. Both method of learning good and if you go fit combine the two, e go help you faster to sabi the forum wella and become a master of your own through the knowledge wey you go don gather for the forum through am.