Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Hunger in the country
by
Makus
on 09/03/2024, 18:45:15 UTC
Hunger is the major challenge Nigerian is facing now and this has affected both the rich and the poor as price of food is increasing on daily basis. Although the rich are a little bit leverage to this situation than the poor because irrespective of the metamorphism of the increment of the of price of food across the country they will still have some money to afford food stocks but the poor are left with no choice than the mercy of hunger and suffering. It's funny to see a country that is well known for agriculture as means of export going through this level of hardship and hunger.


Everybody for this local board know how e be for the country, all of us don hear this hungry matter tire, no be all of us dey live for the country? So why you come dey remind us say hungry dey, when na wattin we dey carry out eye dey see korokoro.

Newbies abeg if una no get better thing to talk make una try rest abeg. This matter of hungry for Nigeria don too much for this local board, if you want make the government hear you, try make you go sign up for opera news hub make you for start to dey write news, if you no sabi am I go teach you, make una free the board from shitpost. Nowadays even full member go up sef dey do the same thing, make una try help the board abeg. Because this na the reason why many of our Senior men no dey like wan near the local board again, because Dem don turn am to something else, people wey we suppose learn from now no dey come board again.

Whyyyyyy na?