Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: What if the Bitcoin was in note?
by
Stable090
on 11/03/2024, 22:02:21 UTC
In all countries around the world there currencies are all printed in paper which is called note though there maybe countries who still use coins till now. All around the world money can be misplaced maybe from your pocket, your hand or maybe your wallet may even get lost but still some people don't feel it when their money get lost because it's not that very high in exchange like in Nigeria where we have our highest currency which happens to be 1k and many other currencies like #500, #200, #100 and others most times we misplace this money and others pick it up with joy of having what you didn't work for but in this recent economy everybody has refused to lose money as usual ( laugh ).
I can’t really remember the last time I saw money on ground, I think people no longer lose money again, gone are those days wey u go dey waka you go see money for ground again, and as our money no even get value again, even if you see 100# or 200# for ground now, no be serious money, but if na before, if you see even 5# or 10# for ground if you see the way person go dey happy because u know Wetin you go fit buy with am. During that time Nigeria never worst like that, we still dey chill that time for dis country, no be like now wey if you hold 1000#, you no go even sabi Wetin u use the money do self.

What if the Bitcoin was in notes and with the same value as it has now, do you think anyone would misplace it or even walk with it on the street. Eventually you see a Bitcoin note will you return it to the owner. Let's be sincere and also see it as fun.
If bitcoin is in note, I no dey sure say people go even dey carry am commot for house self, na for house everybody go dey hide am because mistake fit happen anytime, and you fit lose am, just imagine say you carry 1 bitcoin commot for house you come lose am, you go wan craze now, where you go even start from self,  1 bitcoin na over 100 million naira ooo, where you go even start from if you lose that kin money.

If I see bitcoin note for ground, as long as I fit sabi the real owner of the money, then I go return am, person money no fit make me rich, if I fit take the money and I no return am, my mind no go clear.