Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The causes of hunger in Nigeria
by
Makus
on 17/03/2024, 04:35:31 UTC
It's so unfortunate to see that a common man cannot longer afford food to eat in Nigeria, a country that is well known for agriculture and high level of cultural heritage. I think the root causes suffering, food insecurity and unsustainable development include: poverty, corruption, incompetent leadership, regional insecurity, tribalism, region differences, national policies that do not promote equal access to food for all, environmental degradation, barriers to trade, insufficient agricultural development, population growth, low levels of education, social and economic instability.

Op if you know wattin good for you, you better lock this thread before you chop tag now. Wattin be una problem, abi na because people just dey carry look somekind things commot eye? Wattin be the meaning of this post now, abi them tell you say all of us Nigerian no wattin wattin dey happen for the country? If to say you talk about something else but na Nigeria vital news fine, we go read am come make contributions but see the kind useless thread wey you create baba if you no know wattin to post, make you read from there you go get inspiration to make Bitcoin related post.

Na because of all this kind useless post naim make many of our Senior men no dey like come local board again, how Dem go come place wey newbies dey behave as if them no sabi read, if to say na like this we start you think say we for get any merit sef?

In fact, the vex I dey vex like this ehn, I go take this matter upon myself. ANY NEWBIE WEY I WAN TO LUCK THREAD SAY E NO LOCK AM, THAT PERSON GO CHOP TAG.