Op is noted to be a beginner and may not know it all in the moments of his begining. I think those words of you to him was too harsh for a beginner to bear. You know something when you're being called to order on a high tension manner, you'd probably get lost of your potentials which could lead to depressions here one of such a beginner would feels disappointed of himself.
The Op just clocked a Jnr member that's to say he's still a beginner equal to a newbie.
Baba, some of this beginners them dey look person les Les, imagine wattin I tell, now say make e lock this thread, yet the thread still dey open, if I report now, them go say I do bad. Shabi you dey see am. Another thing wey pain me na be say, them be two wey do this same thing, with just small time difference, so tell my why I no go vex. Them create multiple thread, and the worst thing na besay, all the thread na off topic/ spam post. This no be the first time I dey tell people to lock thread politely, but after a while e come be like say dem dey look person les Les, if I beg Dem Dem go still leave the spam post open. Omor na something dey make man vex, so no think say, I just wake up one morning come dey vex anyhow.
Na for this local board I take get more than 70% of the merit wey I get now, and that na because the board been dey full with quality and inspirational post, wey dey drag other forum users to even come follow us they yarn, men like JJG. So if the local board be like this how them the new ones wan take get am clear. Them say the way you arrange your bed na so you go take sleep put, but when you scatter things for yourself how you wan take make am.