My people, I greet una. Few weeks ago when dollar was 1900, things were very expensive, now wey dollar be 1540 shey things suppose come down? Abeg anything come down for una side? Abi nothing da come down for Nigeria? This matter don tire me. Went to the market yesterday and I actually expected things to reduce due to dollar little stability, but reverse is the case. Seems this country is getting worse. How una see am?
Make una rest na, Because all this matter about Nigeria sef don dey get on ma nerves, see the country wey all of us dey in, no be today the thing start so tay dem don even place am sey anything wey go up for this country no dey actually come down again so me sef I no even dey surprised at all because the wey the price be now na so e go be till God knows when so making a thread out of this matter sef no even dey supported by me because their are so many discussion on going now for this local board about Nigeria and her problem and you for just take this as even a reply or comment for there.