Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Looks like Nigeria is getting worse..
by
Jegileman
on 19/03/2024, 22:52:26 UTC
My people, I greet una. Few weeks ago when dollar was 1900, things were very expensive, now wey dollar be 1540 shey things suppose come down? Abeg anything come down for una side? Abi nothing da come down for Nigeria? This matter don tire me. Went to the market yesterday and I actually expected things to reduce due to dollar little stability, but reverse is the case. Seems this country is getting worse. How una see am?

You are funny and talk like say no be for naija you don dey live your life all dis years. Anything wey go up for dis country dey come down again? Make I tell you something wey I notice when dem wan hike price of something. Let’s say a pack of spaghetti dey 10K and dem wan raise am go 15K, them go first look for opportunity like dis one wey dollar dey rise or maybe like dis kind fuel subsidy stuff. They will now hike the price to like 20K them after a while they’ll now take it back to the 15K to make people feel that they’ve now reduced the price so that they won’t lambast them too much again. If something don move from its initial price for Naija, e don do be that o, you can never get it at that price ever again.