Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: What's the WAY !!!!
by
Pi-network314159
on 20/03/2024, 03:27:38 UTC
  I recently joined dis forum and honestly by now I think say I for don dey blast everywhere but truth be told this thing no be for small pikin. I don go through the different boards as I dey new here and I dey feel like say I too take dis thing serious if I dey read people reply/topics sometimes ehnn e belike say my head wan scatter but anyways I dey look for way I fit take dey package even do Na small small.

Them say Na patient Dog dey eat the fattest bone.
You really dey funny o. You just com new with small post wey you don make naim you say you think say you for don blast everywhere 😂. Anyway na small small naso everybody take start E no really dey easy atol to succeed for this life no easy. No where E easy any where money dey come from, E must show you Pepe. But as time goes on you go understand how r dey work.just take am easy if not for the process of say you wan rush make you meet up fast, you ft go make mistake dem spoil you ACC, because men wey dey this forum no get joy expecially all those oyibo men dem wey dey outside the our board. Any small mistake you just do dem don. Give you neutral trust or even negative trust. So make you just dey careful and make you no go outside this our board go dey Yan about Nigeriann anyhow. Because E don dey become habits of newbies to just come board small thing them don go outside board go dey Yan about 9ja anyhow to get merit not knowing say those men hate us with passion like say them corruption no dey there own country. So just be careful.