I recently joined dis forum and honestly by now I think say I for don dey blast everywhere but truth be told this thing no be for small pikin. I don go through the different boards as I dey new here and I dey feel like say I too take dis thing serious if I dey read people reply/topics sometimes ehnn e belike say my head wan scatter but anyways I dey look for way I fit take dey package even do Na small small.
Them say Na patient Dog dey eat the fattest bone.
Thank god say you know that patient dog Dey east fastest bone, because as I Dey read your post from the beginning I think say you wan run away

because say you find am difficult for this forum, my broda na so this forum be for every member wey you see say them don rank up for this forum, this forum deserve patient if not you you will always feel like you will can’t achieve anything here, many people have come here and they have run away because they they did not find it difficult and anything you are going to do in this life you must start from beginning.
My advice for you be say, never give up, because they said na who give up na him fuck up, so don’t let waiting you Dey see now make you give up and gradually I believe say you go later come Dey use yourself as example for some new members wey go later come, I just can’t stop laughing when you say if you Dey read some topics sometimes e go be like say make your head scatter

.