Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Looks like Nigeria is getting worse..
by
SmartCharpa
on 21/03/2024, 11:55:30 UTC
My people, I greet una. Few weeks ago when dollar was 1900, things were very expensive, now wey dollar be 1540 shey things suppose come down? Abeg anything come down for una side? Abi nothing da come down for Nigeria? This matter don tire me. Went to the market yesterday and I actually expected things to reduce due to dollar little stability, but reverse is the case. Seems this country is getting worse. How una see am?

You dey surprised ni? You don ever see where price go up and later come down in this country? Even people wey bought their goods at cheap rate increase the price when they say dollar price increase. We said the economy is getting worse and na we dey do ourselves, we the human being, na we dey suffer each other for this country, everyone want to use the opportunity they have to become rich at once. Now wey be say dollar price don go down we no see changes from the price of goods, nothing reduce for my side. People greediness too much for this country, no be say them dey buy water oo, but price of pure water just dey increase everyday for my side. I even saw a news that the price of indomie noodle don reduce, i never believe because prices dey hardly go down for this country.