If you go to 4 different stores you will find out that it different prices.
If our government should look into this price of a thing.
Na true wey you talk and government really need to do something about am now as dem don dey try push the exchange rate down by fire by force

but make we see whether dem go fit sustain am. Although the truth be say the exchange rate wey reduce no go make all the price of products just come down like that as if the country don better because e never better. And also, traders go say dem still dey sell old stock but trust naija people, everyone want to take opportunity when dem see am so the prices of products no go just jump down like that.
But if to say na fuel wey drop now, the price go dey reduce by now. If government dey sincere about to better the life of people make dem touch infrastructure and do electricity at least steady for a reasonable time then businesses go flourish. However, make them rejuvenate the price control monitor team or patrol. If business people hear even for radio say government want enter street begin catch people wey dey say at high price, dem go immediately begin change to moderate price but for now wey government never show concern, people go dey sell as dem want with the excuse of old stock.