Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: My people ooo, all these moderators just dey delete my posts anyhow
by
rachael9385
on 28/03/2024, 19:55:16 UTC
I consider those posts quality, I no know, them just dey vex person, make una help me out with tips abeg
When I see this thread, you been already dey ignored but I see the comments and I just feel like to unignore you so that I go fit see the whole thread wey you create but i just see only this things wey I quote.
Although you nah still newbie but  with the whole time wey you done dey here you done supposed to grow pass like this nah, e no dey hard, just dey constructive and you go grow for here. The other reasons why you no get single merit nah because you no dey constructive and nai make moderators dey delete your post, just take 1 while week to write constructive posts you go see say you moderators no go delete your posts them again and them go reward you with merit/s because you done dey make improvements.
Watin O.G @Xal0lex tell you dey correct, make you no dey use AI dey post because them done pardon you well well and the next time fit be ban for you.