Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Is investing in exchange tokens profitable?
by
sokani
on 03/04/2024, 19:18:03 UTC
Ah no dey try to discourage you but wetin I want talk be say investment na risk and the way e happen for BNB and OKB, e fit no happen with Bitget token because e get oda exchange tokens wey no dey do well too like Digifinex token, coin cash (cointiger), Bkex, Bitforex token etc. The main thing wey make BNB coin explode na wen Binance launch their own BSC blockchain wey dey faster and dey cheaper in fees than ETH network. Bitget exchange dey try, dem dey 4th by coinmarketcap ranking, dem get their own wallet and dem fit come up with a service wey go help their token appreciate more in price, so you fit gamble on am.